Sunday, May 31, 2015

LIFE DON SPOIL

Life don spoil. Choi!! Why E be say, Uniben students dey like form seriousness? I dey night class one day, I see person dey form activity with note book, only to dress near the guy, na Nairabet odds him dey calculate. Why?

 Na girls own dey pain pass, person go trek from hall 2 reach pharmacy, dress like Aboki , then E go come carry mirror follow body, E go just read thirty minutes gist for two hours then sleep till six the next morning, Why? Help me ask them why? And some guys nor dey try as well, you go dey come night class you nor go baff? Una go fit just kill person ... I just dey talk my mind sha plus all those boys wey dey wear bling bling like shabba ranks and una chain dey rust ... hand go soon meet una, when the thing go cut una neck , tetanus Toh badt!! .


Still on the matter, I dey wonder why girls dey always talk this thing "like seriously" that day, I dey Noticeboard, dey try copy my result when I hear one girl dey tell her friend. " Babe I've checked yours O, you had like Four carryovers." The idiot wan reply,  Wow!!! "like seriously"... wait wait wait... like are you serious? These girls self.

 Lastly, before I leave, I want advice we boys them , nor dey too enter shuttle bus, na so some go stay line for over 2 hours like say na clearance dem wan do, Bros try give yourself level na because Uniben girls can fall your hand any day anytime. The other day I be dey put ear for the conversation wey dey go on between two girls, na so one for inside dey try tell her friend about one boy wey she meet for Meshai spot. "Felicia, there's this guy in our department. That is liking me oh... I don't know how you see it...." Then the Felicia turn look am "wait wait wait!!! Don't tell me, is it that same shuttle guy I saw you with that day..." Ahh ahn!! Kilo dey (What has happened).   

 Another one wey dey pain me na when girls go dey lie inside bus.. Oh Lord!!! Some girls lie fit make you sleep and the most painful thing be say, the person wey she dey lie give, dey reply with thicker lie... (I jurr tire) and that one still dey inside bus O . Na so one day, one girl just dey lie give her friend "Sandra, you won't believe what happened yesterday, my dad just bought and sent me a car, but you know I can't drive automatic only manual plus the Fuel crisis ..If not I would be cruising it right now" Oooh! (Which kind life we dey live seff) some girls self , anyway na so we see am, happy Sunday.

No comments:

Post a Comment